Monday, 5 October 2015
Fine boy Memphis, Chelsea woes and the Oriental derby.
People, make una no vex say na pidgin I wan use. Wetin do Manchester United for weekend no be wetin dem dey use Eliza English talk. You know as e dey be when you wan folo person wey you sure die say you fit beat fight but before you fold trouser you dey ground? Na so e be Manchester United when Arsenal knack dem akpako for weekend. Before you say Jack Robinson Sanchez don score, Ozil 'okpolo eye' sef score before Sanchez come score again. E be United like film.
For inside nineteen minutes na im all these ones dem happen. True true e be like film. Before United mandem clear eye match don finish. Where e pain United fans dem reash bone na where their skippo Rooney dey. E be like cloth wey don wash. Put body e no go put. But make i tell you; who dey collect £300,000 inside one week to play football no suppose wash. If na head e go dey put. Money too much to dey collect play nonsense. Gimme that money only me go dey play against opposing tem dem. Hustle no dey look back. Abi na Memhis? The boy do fine boy for field sotey e be like who carry powder for pocket and comb to dey use arrange imsef inside field dia. Kepu kepu sef wey dey say the boy dey leave ball pursue one fine girl sef no help am. Weda pesin neva tell am say Ronaldo been keep head for ground, learn ball before e begin pursue woman I no sabi. People tire for am. Mark ball e no go mark. Cross ball for wia. Okay no problem...dey waka like footballer sef no way! Boy tire all man. I sure say United players go dey cut grass now as punishment for the mumu wey dem do yesterday.
Chelsea continued their woeful start to the season as they were outclasses by Southampton who recovered from a Willian free kick to score three goals right inside Stamford Bridge. Davies, Mané and Mitrovic all going into the score sheet. Surprise of the match being when Mourinho substituted Nemanja Matic mid way into the second half even after he was introduced into the match at the start of the second half. I do not know exactly what that was meant to achieve but it certainly failed. Chelsea looked out of sorts as they lost yet again. One has to look beneath the table to find Chelsea's position. Something must be wrong. We do not know what it is for now, but all is definitely not well.
The Match of the weekend in the Glo Nigeria Premier League was played at the Umuahia Township Stadium where Abia Warriors hosted Rangers International. The game ended three goals apiece. Chisom Chikatara scored a hat trick for the Abia side with his second goal drawing the attention of everyone. The way he spun to take the belter is better imagined than seen. The Abia side came from behind twice to level scores before taking the lead finally. Rangers substitute, Egbuchulam however ensured Rangers International went home with a point as he scored the third and equalising goal for the Flying antelopes.
In Owerri, league leaders Enyimba lost to Heartland by two goals to one in a very heated encounter. Enyimba completed the game a man down but gave the hosts a run for the points. Enyimba fave a crucial game that will go a long way in determining if they will clinch their seventh title as they host Warri Wolves in Aba. Wolves themselves have suddenly emerged title contenders as they trail Enyimba in second position by three points.
Photo credit: independent.co.uk
Follow Ikenna Enenta on Twitter: @ikenna005
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Ex International... U finish work for this one..using pigeon to narrate what Manchester United had to go through over the weekend.. I like...football has indeed evolved!!!
ReplyDeleteThanks onye egwu. What United saw during the weekend can't be expressed in Queens English. Lol...
DeleteYes indeed, football keeps evolving.
Ex International... U finish work for this one..using pigeon to narrate what Manchester United had to go through over the weekend.. I like...football has indeed evolved!!!
ReplyDeleteSan san don enta garri no be small, dis one na "mama tongue" matter lol! Well, I guess it's events like these ones that make the sport the interesting one that it is, the unpredictability adds spice.
ReplyDeleteHahaha...things dem dey wey be say wen dem shele you go forget grammar blow venacular!
DeleteYes. The spontaneous nature of the game is what makes it thick.